Wetin make up Injective Ecosystem n Some of d Featured Dapps.

If u look well well, u go see say Injective ecosystem deh large n many project still deh show face everyday both #NFT. but today i go just touch some dApps wey Injective don feature for der dashboard on Mintscan.

First na Wavely, wavely na Defi exchange wey u fit use trade cross chain assets n perpetual market leverage wt better market rebates. ds Dapp get one of d best environment to trade, wit super fast transactions n oda unique features.

wavely get orderbook derivative #Dex , swaps interface, porfolio tracking, rewards n trading histories, wit clean n smooth UI interface. Chk d info graphics below to start to deh trade for wavely, no forget say u fit trade wit 10x leverage n u no need pay gas fees as well.

#Frontrunner na #Gaming project wey focus on #sports engagements, n dem wan be leader for ds space, dem wan achieve ds tyn by combining d bst part of finance n sport betting , all ds na to create quality fan experience.

#Frontrunner na free to play daily fantasy #game, u go fit win real prizes, as far u be real sport fan. u fit download der app today from playstore n app store to get started.