Nigerian goment release 'sick' #Binance executive to travel for treatment ❤️✅

Nigerian authorities don step down charges against di Binance executive wey bin dey on trial.

Tigran Gambaryan, na executive for Binance Holdings, wey bin dey face money laundering charges. E don dey detention since April.

Gambaryan wey be Binance head of financial crime compliance and Nadeem Anjarwalla wey be di exchange British-Kenyan regional manager for Africa bin dey face money laundering charges.

Both of dem bin dey detention but Anjarwalla find way to comot.

Dia charges dey to di tune of $35 million wey anti-graft agency, Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bring against dem.

For di resumed trial for di Federal High Court in Abuja on Wednesday, di EFCC Lawyer request for di court to step down di charges against di Binance oga.

Gambaryan lawyer, oga Mark Mordi, a Senior Advocate of Nigeria (SAN) agree wit di application of di prosecution to step down di charges.

Oga Mordi for im argument insist say di Binance executive no dey involved in di company wider financial decisions.

Tok-tok pesin for EFCC Dele Oyewale tell BBC say di trial of di Binance executive go kontinu even wen dem allow di executive to go for treatment.

However, e no clear how dem go try di company wen di defendant no dey around.

authorities to hook mouth

Charges wey Nigerian gomment bin sama Binance

Di federal goment wen di matter start bin tok say dem dey committed to make sure say compliance wit tax regulations dey and dem go tackle any financial wrong wey dey shele within di cryptocurrency sector

Di goment bin sama legal action against Binance sake of suspected mago-mago activity for dia wey dem say dey cause gbege for Nigeria economy

Federal Inland Revenue Service (FIRS) bin announce for March say dem don formally lodge charges against Binance for di Federal High Court, Abuja.

Two senior executives of Binance Tigran Gambaryan and Nadeem Anjarwalla be second and third defendants for di suit.